+1(514) 937-9445 or Toll-free (Canada & US) +1 (888) 947-9445
Naija Pikin said:
Why are you reminding me of my disability :( :(, I have a speech problem, I am dumb :( :(, I can only hear and write. Please go ahead with your meeting, talk freely in 9ija tongue, I will just be giving my usual sign language.
Pa Awoderu take him son go Ghana, the young man dey enter University for Canada, na amebo I do sooooo... ;)
So French translator dey for google? you be guy man, how u take sabi? :P :P :P :P

Sorry to hear say u no sabi talk :(

Shuo, "Pa Awoderu" go Ghana? Na wao....The man mean business o. But must he be in Ghana?
 
Right said:
Sorry to hear say u no sabi talk :(

Shuo, "Pa Awoderu" go Ghana? Na wao....The man mean business o. But must he be in Ghana?

Jokes may be sometimes expensive. Not everyone can take jokes, some do but with limitations.
 
To the Ma's and Pa's in the house, I think we should be ok with all the jokes flying around. Please at what point do one get to pay the Right of Permanent Residence Fee.
 
seglad said:
Jokes may be sometimes expensive. Not everyone can take jokes, some do but with limitations.

Me I no sabi talk, I have written it here, that I have a speech problem, I only write in reaction to the threads I read on this forum.
However, true talk, jokes can be very expensive. Please any offences are highly regretted, and not intended to spite anyone.
Pa' Right and Pa' I, do have a great deal of respect for all our wonderful naijas on this forum. Have a LOVELY weekend ALL, the good LORD will surely grant all our aspirations, IJN.
I love you ALL. :-*
 
abehola said:
To the Ma's and Pa's in the house, I think we should be ok with all the jokes flying around. Please at what point do one get to pay the Right of Permanent Residence Fee.

Usually after the medicals, but you can pay it even before the medicals, as it is refundable if the application is refused. I am sure the VO will write you at the appropriate time to pay the RPRF.
All the best.
 
@ PA Naija picckin
am really praying for u that interview will be waived for u o. cos i cant imagine aw ur visa officer will cope o.
 
Ladies and Gentlemen
Let us get down to the business that brought us here. I think the jokes and comedy should be suspended
I mailed my doc to Accra on Nov 22 and was received on Nov 24 . My NOC is 4131. I am yet to receive my 2nd AOR though my ecase
is showing --- INPROCESS

Anty TINU how are you.Have you received medicals. I chatted with ANTY IG Yesterday and we had a fruitful discussion.
I do hope my beloved brother SEGLAD is gathering doc, books, clothes to fly with KLM via Amsterdam to Toronto
Seglad, I wish you the very best

Back to business--My fixed bank certificate for proof of fund expire on Feb 13. I will renew it for another 3 months. Do I need to send the new certificate to Accra or wait till I am ask for another proof of fund?
 
Naija pickin and Right,

Make una no crack my ribs for here ooo.

Nice weekend.

Ig
 
my naija PAs and MAs, momo, momsie, babes

Naija Pikin don kill me o, as u na all no say i go ghana, when i dey come back from Muritala i con enter okada(u na no d trafic situation 4 for our country), u na no watin con happen? I buy BB for the first time( as u na no BB na d in tin now 4 naija) i con decide may lauch am, so i decide may i check the forum 4 while d okada man dey drive, as i begin read the post i con begin dey laugh so tey, i laugh fall down for d okada. The next place i meet mysef na 4 hospital bed, i con check my pocket 4 my BB but i no find am ( i con remember say "na naija i dey"). Abeg she u na see am? i dey miss am o i neva even enjoy am. LWKMD!!!

B4 i 4get Babe IG i don get better one for u, abi u na like Kokolet IG abi Mamalet IG? na the one way dey rain 4 time.

(the humor is very good, it helps keep our mind of the process at least temporarily. Besides some us can use this to take a little time out from the business thinking sense to laugh and intaract in such a way apart from the formal and business proposal stuffs )
 
Where omo naija dey find road leave naija some dey leave mansion for dem country come naija.
U na don see the video way D'banj release (Endowed remix)

dem convert SNOOP DOGG name to OLUWASNOOP BABA AJA for the naija e-passport way D'banj give am. He con happy leave him beverly hill mansion 4 naija, d'bamj no waste too much time him close door tell oluwasnoop bye con dey rock Beverly hill mansion.
 
Good member sof this forum!
When an application is reading ''in process'' what does this mean?
 
Awoderu A.A said:
my naija PAs and MAs, momo, momsie, babes

Naija Pikin don kill me o, as u na all no say i go ghana, when i dey come back from Muritala i con enter okada(u na no d trafic situation 4 for our country), u na no watin con happen? I buy BB for the first time( as u na no BB na d in tin now 4 naija) i con decide may lauch am, so i decide may i check the forum 4 while d okada man dey drive, as i begin read the post i con begin dey laugh so tey, i laugh fall down for d okada. The next place i meet mysef na 4 hospital bed, i con check my pocket 4 my BB but i no find am ( i con remember say "na naija i dey"). Abeg she u na see am? i dey miss am o i neva even enjoy am. LWKMD!!!

B4 i 4get Babe IG i don get better one for u, abi u na like Kokolet IG abi Mamalet IG? na the one way dey rain 4 time.

(the humor is very good, it helps keep our mind of the process at least temporarily. Besides some us can use this to take a little time out from the business thinking sense to laugh and intaract in such a way apart from the formal and business proposal stuffs )

Pa Awoderu sorry o!,So ''Fash' di' Rascal'' neva still ban Okada for Lagos airport?. Wetin be the colour of your BB,and the set ringing tone? I dey with some black market mallam now.
Meanwhile something just occurred to me, was it Babe Ig, or Momo Tinu, that asked about some business to do in Canada?, person fit start Okada business there o!, I hear say serious go-slow dey for Calgary and Toronto during rush hour.
 
Naija pikin, okada business no be bad business at all. Infact, you fit start am. U go need very little captial, infact u fit make ursef tush by using power bike instead of d convectional Bajad Boxer way we dey use 4 Naija. as per my bb i no no d ring tone cos i buy am 4 ghana and nobody don call me the color na white with maple leaf.
 
thejackson said:
Ladies and Gentlemen
Let us get down to the business that brought us here. I think the jokes and comedy should be suspended
I mailed my doc to Accra on Nov 22 and was received on Nov 24 . My NOC is 4131. I am yet to receive my 2nd AOR though my ecase
is showing --- INPROCESS

Anty TINU how are you.Have you received medicals. I chatted with ANTY IG Yesterday and we had a fruitful discussion.
I do hope my beloved brother SEGLAD is gathering doc, books, clothes to fly with KLM via Amsterdam to Toronto
Seglad, I wish you the very best

Back to business--My fixed bank certificate for proof of fund expire on Feb 13. I will renew it for another 3 months. Do I need to send the new certificate to Accra or wait till I am ask for another proof of fund?

TheJackson,
1. Your e-cas is in order, I am a post June 26, 2010 applicant; all docs were submitted, and I have received my PER(our own coinage of 1st AOR), my e-cas is still showing IN PROCESS, with added info for 1st application(2007): we started processing your application in september 2007, for 2nd application(2010) :we received your application on 30th August 2010. Your ecas will remain so for now, the next will be DECISION MADE. Meanwhile click on the IN PROCESS it should have added info.
Take note ALL, the ecas will be shut down on Sunday, all VOs are updating from CAIPS to GCMS(GLOBAL CASE MANAGEMENT SYSTEM), a more efficient and up to date system(IT gurus should know about this software).We will begin to have accurate info on our status from next week Tuesday.

2. As per your expired fixed deposit certificate, I do not think it is really an issue, I also sent one that has expired this February, only that in my own case, I got a covering letter from the bank that I have left a standing instruction to roll-over continuously upon expiration. If you did not do this, you can wait until you are asked by th VO, to show up to date POF(my opinion, others may differ).

NOC 4131: Bros una plenty o!, infact na una create the heavy backlog, infact una POF suppose to dey reach $1m ;D ;D ;D
 
Awoderu A.A said:
Naija pikin, okada business no be bad business at all. Infact, you fit start am. U go need very little captial, infact u fit make ursef tush by using power bike instead of d convectional Bajad Boxer way we dey use 4 Naija. as per my bb i no no d ring tone cos i buy am 4 ghana and nobody don call me the color na white with maple leaf.

Pa Awoderu, if the colour na white with maple leaf, then forget am, the phone don reach Toronto. But bros you dey ambitious o!, ''just now'', ''just now'', wey u go Ghana, na im you go buy white BB with maple leaf, wetin you go buy when you get the PR.
Abeg, on this Okada business we fit really start am o, and instead of power bike, we fit use power keke napep, una dey call am keke marwa for lag. We fit go build am for China, please think about this.
Hope you are enjoying your weekend, I will soon be off to a wedding.