my naija poepols, yes i am land, and now i am narrator my landings experienced for canada city.
PART 1
journey is start from moshood abiola university to airport wey Obasanjo is name muritala muhammed. all families is gather by
2.30pm, and we is wait untils
5pm when lufthansa is opens check in. and when it is knack that time gbam!, we is number one families wey they are check in, gmg bag and potmantoes is reach 25, so custom woman look all of wes and do hmmmms, and ask wetin dey scent.i am told her say it naija foods wey i want go use with my families start new life for oyibo man countries.she say carry your wahala go.walahi me i am surprise.now we begin enter,and babe spicey is say bye bye and she is go.airport boys is help us packing loads and cellotape all gmg bags.and we all is go for security screening.that place too the oga is say una plenty oya pass through another corner, and all of we is checked sharp sharp.we come reach NDLEA point, the woman eye open.she is ask me many quastions,how much cash i am carry.and i am told her.but they carry me go meet one big yansh madam who is give me form to fill.who is you? where is you work? how is you get the thing wey you carry.and why cash.that time fear catch me make i talk true,my heart begin make gbim gbim gbim.but i think na normal routine if you carry pass limit, but this poepols come add home video join am.anyway we pass go.
11.10pm we waka enter aroplane.small time aroplane begin run and come fly go up and we don go be that.
5.30am we don begin come down for frankfurt.as we reach for there one old woman, look we look we, come look we again. come ask me,
''hello you must be ogedengbe family'' and i am say yes.she is introduction herself say she is work for IOM,and is come to receive us.she is confirm our boarding pass to join air canada.and we siddon small and small time till
10amand we is flowing for up again to canada city.my poepols the air hostesses for air canada is too shakara and not friends anyone even small pikins.lufthansa poepols is angels,very friendliness and generosity.take note of that my poepols.
PART 2
12:30pm all of we is land for canada airport.and we begin waka comot for inside aroplane,as we is reach door of aroplane,i am surprise as one small girl wey wear cloth like soldier carry me go one corner,say come o sir,who be all this poepols who is follow you,why is all of yous here for canada.i am told her say all is my childrenses and wife. she and another man is look us and laugh small and say go sir.and we come waka go border agency counter.one another small gal is siddon for counter and is ask yes, i am told she say we is new comers.she is ask wetin we carry like food.my wife is begin quotation all and she say stop,and to my surprisation begin help us call am,
''egusi, dry fish, dried okro, garri, oh i know, just the usual Nigerian stuff, you all sure come with all that''.she smile and direction us to immigration office. and for there they are process all of we, and ask me say any goods to follow. i am tell them say if i carry more goods join the one that i have brought come,Goodluck Jonathan fit ban me from coming back to Nigeria. after that she is ask my POF wey i am carries? i am told her. please my poepols take note!!!!!!!. she is ask me to bring everything out make her eyeses see am. so some time they can fit insist on using eye to see your POF.pls take note o!. after that one, them is say, welcome to canada, .......... and we go looking for our properties. my poepols as i am gather our load for baggage claim, some kurukere boys come meet me say i need trailer to carry my load.i say no i need trolley.them laugh, heeheheeeee,kikiki.., and say
''how you gonna do that brother''?.well to cut this short story shorter, i am hire them truck and pay $54.00.
for outside some poepols have wait for us with buses and we load and move fiaaaaam!.land for we house for mississauga, and i come stretch my back, siddon for chair and come ask for chilled Chairman
. open am, swallow small, mess small kpruum
and begin to shine my eyeses.this is the end of my story.thank sir.
Part 3 is tomorrows wey is to come.